Pipo wey dey live for di central bizness district of Port Harcourt City inside di oil rich Rivers State, no go return back to total lockdown from Thursday 14 May, 2020 as authorities don shift am to anoda day.
Afta fours days of di first lockdown wey start Thursday 7 May, di Rivers State Govnor Nyesom Wike announce two days break; Tuesday and Wednesday 12 & 13 of May, 2020 to allow residents of Obio/Akpor and Port Harcourt Local Goment Area of di southern Nigeria state to go buy food and refill wetin don finish for dia domot before di next lockdown.
But last minutes into di next round of di Rivers lockdown, Govnor Wike give anoda state broadcast, on Wednesday night 13 May, say im observe say e hard well well for pipo to collect money from banks to take buy sometin for di two days wey im give so dem no fit buy food, so im don shift di lockdown to resume on Sunday 17 May, 2020.
- Governor Wike demolish two hotels wey no obey lockdown order
- Why Port Harcourt/Obio-Akpor LGA dey total lockdown for Rivers State
For now, Govnor Wike say night time curfew go dey for Obio/Akpor and Port Harcourt from 8pm to 6am from Thursday 14 May to Saturday 16 May 2020 before di total lockdown go resume from 8pm on Sunday 17 May till further notice.
But afta some days of enforcing di first Rivers lockdown, many pipo begin complain say di total lockdown order wey Govnor Wike put no carri human face at all, wen dem compare am to oda places like Lagos, Kano, Ogun and Abuja wey don face lockdown palava.
Dis na tins wey Rivers State goment suppose do before di lockdown continue
1. Create controlled spaces wia pipo fit buy and sell essentials tins during di lockdown.
2. Allow essential services stay open without stress ( Dem already get examples from Lagos, Ogun and Abuja)
3. Distribute palliatives through di use of identifiable and verifiable channels
4. Engage di organize private sector for conciliatory manner wey suggest partnership instead of aggression.
5. Work wit federal and state authorities to guarantee testing and support for health workers and patients of COVID 19
6. Communicate in way (verbal and non verbal) wey go suggest pity, foresight and solution for di pipo.
Di Govnor say di lockdown measure na to stop community transmission of Covid-19 and e dey more important now wey dem don record 16 new casss wey be di highest record of new cases for di oil rich state wey bin get 23 cases.
Dis total lockdown affect only Obio/Akpor and Port Harcourt local goment areas inside di oil rich Rivers State wey get 23 local goment areas for southern Nigeria.
Im say make pipo endure di small discomfort dem dey suffer as na sacrifice for di common good come remind dem to always wear dia facemask and closure of all land, sea and air borders still dey in force.